info@ifra-nigeria.org

MAI PIPUL SE…

bai Edwin Eriata Oribhabor

No bi se man pikin no go fit de trowe yans fo una fo Naija. No bi se man no nou se Naija na di langwej we ol of os don sidon taya de wet, to si hau di levul go chenj fo beta. Tru tru Naija na di veri levul bot wen wi kom hie di won we madam Nafdak bifo bifo de yan, wi go nou se i don mash lain. Na im wi jos trowe fes fo Riva Naija bikos di tin don bi laik agbada we hang fo tri. Wi sabi se Naija na hau wi de, na hau wi de ron tins, na awa nashonal langwej. Naija na somtin we don pas di bottom of di rut we oyibo de kol tap rut. Naija na wetin ol of os want fo awa sef, fo ol of os an fo wi ol. As di tin kom bi laik dis, plenti pipul de se mek a de yan fo Naija. Dem se na fo onli laik dis dem go tek si ol di waka we Naija don de waka. Wen mai pipul don tok, hu bi mi to se a no go ansa. Na im bring dis arenjment fo propa Naija we una de rid so.

Awa pipul se na tri we nie tri na im mek monki gada swaga, na im mek am fit de jomp from won tri to anoda laik se na majik. Notin de hapun. No bi majik, no bi jas, na jos wetin monki don sabi from bele. Naija, we wi de kol Pidgin bifo no bi tode wi de insaid. Evride, di Langwej de gada, an if una go kash wetin de, na im bi se manpikin sopoz du somtin laik dis to totori una.

If dem put exam fo graund nau se, wetin bi mai pipul se…, evribodi go pas bikos di tin no get beni beni. Mai pipul fo Naija na im bi “My people” fo grama. So, if wi kom join am se “mai pipul se…” wetin wi de tok na “my people said…”, “my people have directed…”, “my people have spoken..” or mai pipul tok se mek a du dis or mek a du dat. Jos laik dat. Di taim we wi de nau, na taim fo Politiks we Hausa de kol “siasa”. Na di taim we yu go hie plenti pipul de se “mai pipul se…”, “mai pipul se…” Bikos wen meni pipul won join politiks, dem sabi du wayo sme sme laik se dem no won du, laik se dem de fos dem to join. Na from ye yu go kom de hie somtin laik; “mai pipul se…, mai pipul se...” Dem get difren difren stail we dem de yuz. Som of dem go jos du won kain ogbeju mitin wit dia pipul, an kom se “mai pipul se dis, mai pipul se dat to get rizin to enta politiks. Som go ivun de fo jant anauns se dia pipul don tel dem se if dem no kom join fo wetin de graund, dia komuniti go kpafuka. Dem go yan dia pipul se na onli dem go fit kom kari dem komot fo wahala. Som go ivun yuz God tek lai.

Dis kain “mai pipul se...”, “mai pipul se...” kom tek mai maind go hau som pipul laik to de yuz di nem of devul to kova eni tin we dem du we no gud fo ai. Pesin go tek im koro koro ai tek du yeye an kom se na devul push am, na devul kos am, na devul wok, echeteram echeteram. Afta dat, dem go enta wayo sori ai, mek pipul tink se dem no nou wen dem du.

Mai pipul se... na patan, na koret stail we som pipul tek de enta politiks. If dem no du am laik dis i go bi laik se na dem de hongri enta. If yu won enta politiks, kom aut wit big maind, sho se yu sabi wetin de an wetin yu want fo yo pipul. No du kona kona tek enta an kom tel os se na fos dem fos yu. Na wetin de kari os go bak bi dis. Ogbeju politichan berekete. Hau pesin go enta politiks, i no get plan fo graund? Dis taim, wi no send fo mai pipul se politishan dem.

This email address is being protected from spambots. You need JavaScript enabled to view it.

(received 25/11/2010 — Published 02/12/2010)

Find us

IFRA
Institute of African Studies
University of Ibadan
Ibadan, Oyo State
Nigeria

Locate us



View Larger Map

IFRA Resource Centre

Opening hours: 9am to 4pm, Monday to Friday