info@ifra-nigeria.org

Mi Aan mai Frends (2)

bai Edwin Eriata Oribhabor, Naija Langwej Promoter, Abuja-Naijiria

Mai Frend: Afta wi yan finish di oda taim, somtin jos de ron-ron fo mai hed. A stil de tink wetin fit kari mi komot kom Abuja. A neva si enitin at ol. Laif tu kost fo Abuja. Hau una tek de manej fo dia sef? Pesin go rent won chikini haus wen bi laik bois-kwota fo 500 tausand naira. Won smol kona-kona haus fo 300 tausand. Evritin na tau-tau, tau, tau. Landlord and agent no get sori ai fo enibodi. Dem no de ivun alau pesin drink wota drop kop. Evridé ol of dem wen get govanment go de poshu pipul wen de sel fo kona of rod. Fo Abuja, na evride pesin go de si Ben Johnson ron-ron. If yu ask mi hau a tek nou, a go tel yu won taim se, wi de si am fo niuspepa and telivishon. No bi mi and una fo una Abuja. Dis una Abuja. Hmmm!

Mi: Bot na wa fo yu o! Hau yu tek sabi evritin laik se yu don de ste fo Abuja? No bi pipul de liv fo hia? Wetin yu de tok sef? Hu kom tel yu se na awa Abuja and no bi yo Abuja? Yu no nou se dis na senta of uniti wia dem se mek ol of os fo Naija gada sopoz liv and ste as won?

Mai Frend: Mek una de tink se una de liv. Hu tel yu se yu de liv? Wich kain laif una de live? Pesin no fit sel komon akara and agidi oo bred fo rod... Hau pesin go tek chop wetin im laik? Na fo supamaket na-im dem want mek pesin go bai kpomo and shaki?

Mi: Na tru yu tok o. A don tink dis mata bifo. A don ivun rait am fo won of mai puem-dem.

Mai Frend: Abeg no bi puem awon hia. Tok anoda tin. Yu an puem sef...

Mi: Si yo sef... yu de tok laik se yu don liv fo Abuja bifo. A won tel yu hau di tin bi yu wan yan yo maut rof. Ivun if yu kom Abuja todé, na ste yu go ste. No bi liv yu go liv bikos to ste and to liv fo Abuja na tu-difren tin. Som pipul de liv, som pipul de ste. Abuja no bi fo smol pipul we no get ’’heart’’. Yu most kom an du am wit dem jos laik ol dos smol-smol bois we de sel fo rod. If dem poshu dem tode, dem go kom tumoro. Fo dia maind, dem go se, “if una laik poshu os, na ol of os get dis Abuja.” Dat na wai pesin fit de fo dis ples de luk dem, dem de luk os. Wi de tok fo awa maind se, ’’wi go si hu go taya.’’ Wich kain yeye taun bi dis sef? Dis Abuja...hmmmm!

Mai Frend: Yu tok abaut liv an ste? Wich won kom bi dat?

Mi: Yes na! If yu get haus fo autsaid Abuja siti senta, na ste yu de ste. Bot if yu de fo insaid di siti senta, na liv yu de liv. Na so di tin bi. So, yu no sabi dis bifo? Abuja get senta, Abuja get kona. Som pipul kom Abuja tink se na moi-moi. Abuja no bi moi-moi. Na so dem kari demsef kom enta siti senta to stat dia laif. Bot wen wota kom pas gari, dem ron go kona go kontiniu dia laif. Bot wit smol lok, som stil kom bak to siti senta. Som stat from kona and from dat kona, dem land fo insaid siti senta propa de rok ol di rok wit dem-dem. Na so laif bi.

Mai Frend: Hmmmm! Dis una Abuja sef. Mai kredit don de waka. Abi na yu kol mi?

Mi: Abeg no drop na mi kol yu. Na yu kol mi di last taim. Na wen a don de giv yu ‘free’ leksho na-im yu kom de tok abaut kredit. Ok. So, mek wi tok tumoro na.

Mai Frend: Abeg de tok a de hia yu...

Find us

IFRA
Institute of African Studies
University of Ibadan
Ibadan, Oyo State
Nigeria

Locate us



View Larger Map

IFRA Resource Centre

Opening hours: 9am to 4pm, Monday to Friday