info@ifra-nigeria.org

Mi Aan mai frends-dem fo telifon tok (1)

bai Edwin Eriata Oribhabor, Naija Langwej Promoter, Abuja-Naijiria

Mi: Gud monin o!

Mai Frend: Hai! Woz op?

Mi: Wich won bi hai fo dis kain korekt moni? Wetin bi woz op? Na wen dis won stat? Na oyibo land yu de?

Mai Frend: Abeg o! No vex. Na Lagos a jos de o! As yu si mi so, a de fain wel-wel. Gud monin. Sori. Hop se yu no vex?

Mi: Na nau yu tok laik Naija pesin. Vex no de fo mai dikshonari. Ivun if pesin wan vex no bi eli mo-mo laik dis na. Abi?

Mai Frend: Ok, hau fa? Hop se evritin na korekt-korekt? Hau Abuja?

Mi: A jos de manej mai laif smol-smol.

Mai Frend: Wich kain smol-smol yu de manej yo laif wen yu an Oga Jona de enjoi togeda?

Mi: Oga Jona! Hahahaaa! Yu trai wel-wel. Yu no sabi se fo Abuja evri-bodi de fom im oun levul? From Aso-Rok to Wuse Rok, evri-bodi wan du laik se na anoda kontri dem kom from. Oga Jona de du im oun, mi de du mai oun, evri-bodi de du im oun. Evribodi de ansa im papa nem.

Mai Frend: Haba! Na so? Fo dis awa Naija? Dat go wok so?

Mi: Wetin yu tink? A bi yu no de fo Naija?

Mai Frend: Abeg no mek mi laf. Hau yu go de Abuja de tel mi se yu neva waka enta Aso Rok, folo dem rok di rok smol? Yu no si di bojet fo fud as di tin de klaimb? If onli fud bojet klaimb rich di levul wen i don rich nau, na wetin oda bojet-dem go bi? Dem go klaimb and ron?

Mi: (laf wan kil mi) Wetin konsain mi wit dia bojet? Weda bojet de klaimb oo bojet de ron na dem sabi. Na dem-dem govanment dem de. As yu si mi so, na hau man pikin go ste jeje, get mai oun pe to setul mai pikin skul moni na-im de mai hed. A no fit rimemba wen a put ai fo dia Telivishon. Ivun niuspepa sef no de fo mai ajenda. Mek dem de bojet demsef fo eni kaind bojet. Dat na dia toro. Won de go bi won de, monki go go maket i no go riton.

Mai Frend: Si as yu fest laf. So yu de laf? Yu de laf abi? Wi de si yu fo intanet and telivishon evride an yu de tek laf de ansa sirios mata. Yu de trai sha. Bot yu sopoz join dem fo politiks nau. Na nau yu go stat to de du folo-folo de folo dem so dat wen yu ritaya fo govment wok, yu go join dem fo politiks wok. If yu no nou se politiks na wok, mek yu nou nau. Na nau yu go de du folo-folo. Go intanashonal konfrens senta eni taim dem de du konfrens. Mek yu sho se yu sabi opun yo tati fo dem, kari dia hand-bag and yu go si se won de lok wen bi laik oyel fit shain fo yo hed. Yu no sabi se na fo insaid politiks moni tek bele tosh graund?

Mi: Si di we yu de tok to mi laik se na smol-pikin yu de tok to. Na hand-bang na-im a kom kari fo Abuja abi? So, yu si mi laik pesin we no laik moni abi? Yu tink se na buildin a kom luk fo Abuja abi? Wai yu tink se na haus and rod a kom kaunt fo Abuja? A no ivun nou weda dem sho mi fo telivishon. Ataims, som pipul de tel mi se dem si mi. Bot a no kom laik di we yu de yan sha...si mi si trobul o! If no bi se na yu kol mi, a fo tek stail kot di kol and tel yu se na netwok problem.

Mai Frend: No! No! No! No bi laik dat. Na mi and yu de yan. No bi poblik mata. Na yo frend de tel yu im bele. If a no tel yu mai bele, na hu go tel yu? No vex... Na beta tin a jos de tel yu. No du-am laik se na kworel. A no jos de nak tit. Weda yu laik wetin a de tok oo not, na yu soko. Na yu nou weda na so-so puem-puem yu go de du fo Abuja wen ol yo met-dem de kolekt dia oun chia of di nashonal kek. Na yu nou weda yu go sidon dia de du puem-dem and puem-dem. Mek yu sidon fo dia. Yu hia? Yu want to bi Wole Soyinka abi? Hmmm! Ok…ooo!

Mi: Si wetin yu de tok. So if a bi laik Wole Soyinka na bad tin? Yu no de si as im de waka raund Naija, evriwia and di wold witaut eni wahala. Yu don si am go eni embasi fo Naija and obodo-yibo de luk fo Visa bifo? Todé, im fit de Naija, tumoro, yu go hia se im don enta Yanki. Anoda dé, yu go si am de yan from jant. CNN de luk fo am enitaim gbege de fo Naija. UNESCO pipul no go alau am rest. UNITED NATIONS get im nem fo dia rekod. NOBEL PRIZE pipul don giv am awod. Hu wan trai am? Hu no laik beta tin? Yu no laik am? If pesin se im wan bi laik am, no bi bad tin at ol. Na dat kain pesin wi sopoz folo im stail. Wole Soyinka get nem plos moni. Som get moni, dem no get nem. Som get nem, dem no get moni? Yu sef wetin bi yo oun?

Find us

IFRA
Institute of African Studies
University of Ibadan
Ibadan, Oyo State
Nigeria

Locate us



View Larger Map

IFRA Resource Centre

Opening hours: 9am to 4pm, Monday to Friday